Miracle Church for Yahoo Boys in Abraka
Miracle Church for Yahoo Boys in Abraka, sounds funny right but indeed it’s real.
(abeg i don taya for too many grammar) If you be yahoo boy for Abraka and you never hear of APM, then you never stay the town tey!
Like play like play this church get over 400 active members on Sundays and many other visiting members wey don dae pass thousands on very special programs.
As we dae yarn so, the church still dae under construction but the speed e dae take grow pass how saturday and sunday dae take fly.
I hear say na one apostle dae run matters for the church. The apostle na one time carpenter before before.
But as Local man can noh nah cope, 2 seconds him turn apostle about three good years wey don pass like this like this.
And for this three years so, the church don get branch for Warri, Obiaruku and other places wey i never still know.
Wetin i wan really tell una be say, The church get Special programs wey dae offer yahoo yahoo boys 2 seconds cash out from their maga.
E get one day wey the apostle call one guy come front of the church, The apostle yarn am say like this ehhnn him dae expect 10 million naira from him client.
The Guy gree ohh!! Na once the apostle pray special prayer for am.
E no tey ohh, the guy come give testimony ohhh!
As in ehhh, every Sunday na testimonies of Quick confirmation wey dae bust brain.
And them talk say all na to the glory of baba God wey dae heaven oh
Like say i never hear enough, na once one G wey dae my corner yarn me say “e no geh how you go be member for this church wey you no pick 2 seconds“
To get more gist from am, i come press the matter go front, the Guy yarn me say if i dae look for miracle; na the best place i come so.
But the problem be say, before i fit touch body with the apostle, say e go pass membership alone.
I gaz dae special to the apostle, say i go be better tither(person wey dae pay tithe wella)
Or if him spirit just like me, him fit call me.
Abeg how una see this matter wey i carry come so.
Make una shake body for the comment box below!
- Related Posts…
- Type of students you will find in Delsu, Abraka
- Video: Angela Okorie Twerks her Massive Mummy Bumbum
- 43-Yr-Old Pastor, Israel Philip Nabbed For Allegedly Defiling Neighbour’s Daughter In Lagos
Get the latest Gist and updates from the our social media links below.
- Like our Facebook Page
- Like Our Instagram Page
- Join our WhatsApp Group
- Follow Us on Twitter
- Join Our FACEBOOK GROUP
- Receive FREE Daily Updates Via Email
Lwkm!
The way people just open organizations and name it ‘church’ is appalling and unethical… This is just too much abeg. You don’t see mosques flying up and down… God will help us.
No be small Tori be this ooo.. But before person go start church e no supposed to Ask questions. Aboy make people get sense Jesus don’ yan is how the matter go be o
Try reach the church and see for yourself, APM is build on the word of God and everything wen apostle dey use dey the holy bible. They are other things to worry about not the man of God trying to raise people up